Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 8:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 But God si fault for inside, so E kon sey, “Di day wey I go make new agriment with Israel and Judah house, dey kom.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 8:8
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

My pipol, make una open una ear as una dey kom meet mi; make una kom meet mi and una go get life! I go give una kovenant wey go last forever kon give una di blessings wey I promise David.


God sey, “Di time dey kom wen I go choose betta king from among David shidren-shidren. E go rule di land with wisdom kon do wetin dey korrect and good.


God sey, “Di time dey kom, wen pipol nor go use my name take swear sey, ‘Yu bi God wey dey alive wey take Israel pipol komot from Egypt.’


bikos time dey kom wen I go bring my pipol, Israel and Judah kom back to di land wey I give dia grand-grand papa and e go bi dia own again. Mi, wey bi God, don tok.”


God sey, “Di time dey kom wen I go make pipol and animals full Israel and Judah land again.


God sey, “Di time dey kom wen dem go ribuild evriwhere for Jerusalem wey bi my town; from Hananel Towa for west go rish Korna Gate.


I go make kovenant wey nor dey end with dem sey I nor go ever stop to do good tins for dem and I go make dem fear mi with all dia heart, so dat dem nor go turn leave mi again.


I go make kovenant with dem wey go make dem dey save forever. I go make dem prosper and dem go many well-well. I go make sure sey my temple dey for dia land forever.


bikos dis na my blood, wey bi di kovenant wey go make God forgive pipol dia sins.


E kon tell dem, “Dis na my blood, di kovenant blood wey I pour for evribody.


Den Jesus tell en disciples, “Di time dey kom wen una go won si Man Pikin, but una nor go si am.


Like dat, Jesus still take di cup afta dem don chop finish kon sey, “Dis cup wey God give una, na di new agriment with my blood.”


Instead, pipol suppose pour new wine inside new wine bag.


Afta dem chop finish, Jesus take di cup kon sey, “Dis na my blood wey God take make new kovenant with una. Make una always dey drink am to remember mi.”


Na God make us fit do dem, so dat wi go serve di new kovenant; dis nor bi di law wey dem rite, but na di one wey koncern God Spirit, bikos di law wey dem rite dey bring deat, but di Spirit dey give life.


Nor bi only una I dey make dis kovenant with,


Una don kom meet Jesus, di pesin wey God use take start di new kovenant with en pipol and una don kom meet di blood wey dem spray and dis blood dey tok betta word wey pass Abel own.


Bikos God swear like dis, Jesus don make us dey sure of di new kovenant wey betta pass.


Wen God tok about di new kovenant, E mean sey di first one nor matter again. And anytin wey don old and nor get use again, go soon disappear.


But Christ ministry big and betta pass dia own and na di new kovenant (wey bi di new agriment) betta pass. Bikos na thru God promise dis kovenant take kom, so Christ don bi di middo-man between wi and God.


Na dis make am bi middo-man for di new kovenant, so dat pipol wey e koll go fit receive di propaty wey go dey forever. E promise us dis propaty, wen e die to free us from di bad-bad tins wey wi don do wen di first kovenant still dey.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ