Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 8:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 But Christ ministry big and betta pass dia own and na di new kovenant (wey bi di new agriment) betta pass. Bikos na thru God promise dis kovenant take kom, so Christ don bi di middo-man between wi and God.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 8:6
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem go ask kon follow di road wey dem dey pass go Zion. Dem go make kovenant wey nor dey end with mi and dem nor go break am.


Like dat, Jesus still take di cup afta dem don chop finish kon sey, “Dis cup wey God give una, na di new agriment with my blood.”


wey bi Israel pipol, go fit asept Christ. Na dem God choose as en own shidren, E make agriment with dem kon give dem en law. Na dem get di temple and wetin God promise.


Dat time, una dey without di Mezaya and una nor get share for Israel blessings and since una nor get hope and una dey without God for dis world, una kon bi strenja to God kovenant wey E promise Israel pipol.


Bikos na only one God dey and na Jesus Christ wey kom as human being, bi di pesin wey dey bring God and human being togeda.


Di trut dey give dem di mind sey dem get life wey nor dey end and na God wey nor fit lie promise dem dis life even before E kreate di world.


Una don kom meet Jesus, di pesin wey God use take start di new kovenant with en pipol and una don kom meet di blood wey dem spray and dis blood dey tok betta word wey pass Abel own.


Bikos God swear like dis, Jesus don make us dey sure of di new kovenant wey betta pass.


Like dis too, wi don get betta promise and bikos of dat, wi go get God karata wey go free us from di bad tins wey dey for dis world.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ