Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 8:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Di priest work for di temple bi like wetin dey happen for heaven. Bikos wen Moses dey one build God house, God tell am: “Make sure sey evritin bi like di design wey I show yu on-top di mountin.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 8:5
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E still gi-am di plan, just as e get am for mind to build di kourtyard and di rooms wey round dem; di store room wey dem go put di temple tins and di gifts wey dem dedikate give God.


King David sey, “All dis tins dey for di plan wey dem rite, just as God kommand mi.”


“Naw, make sure sey yu make dem, just as I show yu for di mountin.


Yu must make am with all di tins wey dem go put inside, just as I show yu.”


“Yu go build di tent as I show yu for di mountin.


Take wood make di altar kon put hole inside akordin to di plan wey I show yu for di mountin.


Dis na how dem take make di lampstand: from di top go rish bottom, dem make am with gold, just as God show Moses.


Bikos God warn dem for dream make dem nor go back go meet Herod, dem kon pass anoda road go dia house.


God give di Tabanako to awa grand-grand papa dem, di house where dem go for woship am, just as E sey make Moses build am.


Bikos all dis tins na shadow for di tins wey go kom, but di really tin, na Christ!


Moses Law bi like shadow wey dey show good tins wey dey kom. Di shadow nor bi di tins, bikos di sakrifice wey dem dey offa evry year nor fit forgive pipol dia sins.


Na faith make Noah build ark afta God warn am about wetin go happen. E obey wetin God tok and na di ark save en and en family. Na di same faith Noah take kondemn di world, kon inherit di raitiousness wey dey kom.


Make sure sey una dey obey di Pesin wey dey tok to una! Bikos if Israel pipol wey nor gri hear dia oga Moses word for eart nor eskape, how wi go fit eskape, if wi nor gri hear di Pesin wey dey tok to us from heaven?


Wi get altar where di workers for di Tabanako nor fit chop from.


Dis na sign make wi for fit undastand sey: Di gifts and sakrifice wey di priests dey offa for God pipol, nor fit make dia mind klean.


“Wi kon sey, ‘If dem tell us or awa shidren-shidren dis kind tin tumoro, wi go ansa dem sey, “Si di fine altar wey awa grand-grand papa build for God, nor bi for burn ofrin or sakrifice, but na to dey remind wi and una.” ’


Afta all dis, I kon si di temple for heaven open and di kovenant tent dey inside.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ