So make una look heaven and eart! Di heavens go vanish like smoke, di eart go tear like old klot and all en pipol go die like fly. But wen I diliver am, e go last forever. My viktory, na di final one.
Love nor dey fail and e go dey forever. Pipol nor go profesai forever and doz wey dey tok with difren-difren language, go stop. For dat time, wi go forget evritin wey wi know.
Na God make us fit do dem, so dat wi go serve di new kovenant; dis nor bi di law wey dem rite, but na di one wey koncern God Spirit, bikos di law wey dem rite dey bring deat, but di Spirit dey give life.
Una don kom meet Jesus, di pesin wey God use take start di new kovenant with en pipol and una don kom meet di blood wey dem spray and dis blood dey tok betta word wey pass Abel own.
But Christ ministry big and betta pass dia own and na di new kovenant (wey bi di new agriment) betta pass. Bikos na thru God promise dis kovenant take kom, so Christ don bi di middo-man between wi and God.
Na dis make am bi middo-man for di new kovenant, so dat pipol wey e koll go fit receive di propaty wey go dey forever. E promise us dis propaty, wen e die to free us from di bad-bad tins wey wi don do wen di first kovenant still dey.