Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 8:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Dem nor nid to tish one anoda about mi wey bi dia God, bikos all of dem, both small and big, go know mi.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 8:11
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den e tell Solomon, “My pikin, I kommand yu sey make yu know yor papa God and make yu use all yor mind and heart take serve am. E know all wetin wi dey tink and wetin wi wont. If yu go meet am, E go take yu, but if yu turn from am, E go abandon yu forever.


King Hezekaya show sey e happy well-well as Levi pipol use all dia mind dey serve God. Dem do di feast for seven days, dey give ofrins and dey tank God wey bi dia grand-grand papa God.


As for yu Ezra, make yu use di wisdom wey yor God give yu, take choose ofisas and judge wey dey obey God and na dem go rule di pipol for West Eufrates. Yu must tish evribody wey nor know di law.


and pipol go dey sey, “Make wi klimb go God mountin. Yes! Make wi go Israel God Temple, den E go tish us wetin E wont make wi do and wi go waka for di road wey E choose. Bikos betta tishing dey kom from Jerusalem and God dey tok to en pipol from Zion.


Na only mi go tish una pipol and I go give dem peace kon make dem prosper.


I go let dem know sey na mi bi God. Den, dem go bi my pipol and I go bi dia God, bikos dem go kom back kon serve mi with all dia heart.


“Pipol nor go nid to tish each oda about how to know God, bikos evribody go know mi; both doz wey poor and doz wey get money. I go forgive dia sins and I nor go remember di bad tins wey dem do before. Mi, wey bi God, don tok.”


Den all di sojas oga with Johanan wey bi Kareah pikin and Jezanaya wey Hoshaaya born kom with oda pipol


so I kon koll Johanan, di sojas offisa, doz wey dey with am and di oda pipol.


Den, Judah pipol wey remain, wey don make up dia mind sey dem won go Egypt, I go make sure sey, dem distroy dem finish. Both big and small go die for Egypt; weda na for war or honga. Pipol go si dem dey fear and dem go trit dem anyhow kon use dia name as curse.


Bikos both rish and poor pipol dey make money with wayo. Even profets and priests join dem dey deceive pipol too.


Evribody go know sey na mi dey protet Israel and dem bi my pipol. Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”


Just as wota full sea, na so too dem go know about God glory for evriwhere for dis world.


Na so di profets rite sey, ‘God go tish evribody.’ Anybody wey hear wetin my Papa tok, go kom meet mi.


Evribody, both small pikin and big pipol, dey bilive wetin e dey do and dem bilive sey, “Na God gi-am pawa!”


As for una, di Holy Spirit wey Christ give una, dey stay inside una, so una nor nid anybody to tish una again. Evritin wey di Holy Spirit dey tish, na true and lie nor dey inside. Just as e don tish una, make una stay inside am.


Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ