Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 7:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 and e betta pass any oda high priests. Jesus nor nid to offa sakrifice evriday, like di oda priests wey dey offa for dia own sins and for di pipol own. Bikos na wons and for all e sakrifice ensef for evribody, wen e die for di cross.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 7:27
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Doz priests wey kom from Levi tribe wey bi Zadok shidren-shidren, na only dem go fit kom inside my present kom serve mi. Na mi, wey bi God wey get pawa dey kommand yu. Yu go give dem one yong melu make dem offa as sakrifice for sins.


“Wen Aaron sakrifice di melu as sin ofrin for ensef and en family,


“Afta dat one, e go kill di goat for di sin ofrin for di pipol, take di blood go di place wey holy pass kon rub am for di plate and di Kovenant box front, just as e do di melu blood.


“E go give one melu as sakrifice make God for forgive en and en family dia sins.


Bikos as e die, e don ovakom sin forever, so di life wey e dey live naw, e dey live am for God.


thru am, God don build una togeda as where E go dey stay thru di Spirit.


Make wi love one anoda, just as Christ love and sakrifice ensef as ofrin wey get betta smell to God, bikos of us.


E die for us, so dat e go free and klean us from wikedness kon turn us to en own pipol wey like to do good tins.


Na God dey choose High Priest wey go ripresent pipol for en present. Di priest dey offa both gift and sakrifice for dia sins.


Bikos of dis, e dey offa sakrifice for en sin and di pipol own.


If to sey e dey dis world, e nor for bi priest at-all, since na thru Moses Law dem take dey choose priest wey go offa sakrifice.


Na wons Jesus enter di place wey holy pass. E nor enter with goat or ram blood, but na with en own blood, so e don save us forever and ever.


wot of Christ blood wey klean us from deat, so dat wi go fit woship God? Dis na di Christ wey offa ensef to God as di rite sakrifice for awa sins and e do am with di Holy Spirit pawa.


Christ nor nid to offa ensef evry year like di High Priests dey do for di temple with animal blood,


bikos if na so, Christ for dey kom die for us evry year since di time wey God kreate di world. But nor bi so! E die wons and for all, so dat awa sins go-go forever.


na so too Christ die wons, as sakrifice to forgive pipol forever and naw, e go bring salvashon to doz wey dey wait for am.


But na only di High Priest dey enter di Holy Place wons a year. For der, e go first offa blood for en sins, before e go offa for di pipol own, bikos dem nor know wetin dem suppose to know.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ