Anybody wey promise sey e go pay strenja debt, make una hold en propaty until e pay am. Make una hold di propaty if e dey do am for pesin wey kom from anoda kountry.
“ ‘Dat ruler go enter agriment with many pipol for one week, den for di middle of dat week, e go stop all di sakrifice and ofrin. Den e go start one bad tin wey go kause wahala and tins go bi like dat, until di time wey God sey E won distroy di wayo pesin wey kause di wahala.’ ”
Afta dem chop finish, Jesus take di cup kon sey, “Dis na my blood wey God take make new kovenant with una. Make una always dey drink am to remember mi.”
Una don kom meet Jesus, di pesin wey God use take start di new kovenant with en pipol and una don kom meet di blood wey dem spray and dis blood dey tok betta word wey pass Abel own.