15 Dis matter klear well-well afta God selet anoda priest like Melkizedek.
God don promise and E nor go break di vow wen E make sey: “Yu bi priest forever like Melkizedek.”
but di seed nor get rut, bikos di word wey e hear, nor strong for en heart, so wen trobol kom, e nor go fit bear-am.
God still sey, “Yu bi priest forever as Melkizedek bi.”
Even doh Moses Law sey priest must kom from Levi family, dat kind priest nor fit make pesin dey pafet. So anoda priest like Melkizedek must kom and e nor bi like priest wey kom from Aaron family.
Evribody know sey na from Judah tribe, Jesus from kom and Moses Law nor sey make priest kom from dat tribe.
E nor selet dat pesin bikos of en grand-grand papa dem, but na bikos en life nor go ever end.
E nor get papa or mama, e nor get story at-all, en days nor get where e for start or where e go end, but e bi like Man Pikin and e bi priest forever.