My woman! Di one wey fine pass among wimen! If yu dey find mi, make yu follow my animals footstep rish where I dey kon kare for yor small goats near di shepad tent.
God tell en pipol, “Make una stop and look round. Mi, wey bi God, don tok. Ask for di old way wey bi God own and make una follow am.” But dem ansa, “Dat nor bi di way wey wi like to follow!”
But di seeds wey fall for betta groun, na di pipol wey hear God word, hold am with betta mind, dey obey God and bear wahala, so dem kon bear plenty fruit.”
Since wi get many witness wey surround us, e good make wi drop evry load and sin wey dey make us fall, so dat wi go use awa mind live di life wey God wont.
Anybody wey dem suppose to katch, dem go katch am. Anybody wey swod go kill, dem go kill-am with swod. So, God pipol must bear well-well and get faith.