If wi dey prish, make wi prish well. If wi dey give, make wi do am with betta mind. If wi dey lead odas, make wi do awa best. If wi dey do good to odas, make wi do am with happiness.
So my friends, make una dey strong and nor let anytin shake una. Make una always dey do God work, bikos una know sey, evritin wey una do for God, get gain.
If true-true una get faith and una leg strong for groun, den una go get hope kon whole di gospel wey una hear. Dem don prish dis gospel give evribody for di world and mi Paul don bi di gospel savant.
Wetin I wont bi sey, wen una don really undastand God sekret wey dey inside Jesus Christ, make una heart dey strong with love, so dat una go get evritin wey una wont.
Nor bi only thru ordinary word wi take prish di gospel give una, but na with di Holy Spirit pawa and wi show sey, evritin wey e tok, na true. Una know how wi dey live and help una.
And una really dey show love to di Christian brodas and sistas for Masidonia. My brodas and sistas, wi dey beg una sey, make una kontinue to dey do like dat.
But as God Pikin, Jesus dey faithful for God house. So wi too go get share for di house if wi bilive and get konfident for awa hope wey dey inside Christ.
Dem kom back kon tell Joshua, “Nor send all di sojas go, about two or 3,000 sojas go distroy di whole Ai town. Nor disturb di whole sojas, bikos Ai na small town.”
So, my friends, as una dey wait for dis tins, make una do wetin una fit do, so dat una go get peace and una go dey without stain or fault wen una go enter en kingdom.