Na Amram born Aaron and Moses. Dem choose Aaron and en shidren-shidren to dey kare for di holy tins; burn incense to take woship God; to dey serve God and dey bless di pipol with God name forever.
Dem go meet King Uzzaya kon tell am, “E nor good make yu offa incense give God by yorsef, bikos dat na di work wey priests dey do and na Aaron shidren-shidren dem anoint to dey offa incense. Make yu komot from God house, bikos yu don disobey and nor gri respet am!”
“Make yu take Aaron and en sons go di tent gate, bring dia garments, di anointin oil, di yong melu for di sin ofrin, di two ram and di basket of bread wey nor get yist.
Dis na warnin to Israel pipol sey, “Anybody wey nor kom from Aaron family, nor go fit burn incense to God for di altar. If not, e go die like Korah and en men.” All dis happen akordin to wetin God kommand Eleazar thru Moses.
Den e tell Korah and doz wey dey follow am sey, “Tumoro morning, God go show us who bi en own and who dey holy. Na only di pesin wey bi God own go fit enter en Holy Place.
But na yu and yor sons go do di priest work, evritin wey dey di altar and di Holy Place. And yu must work, bikos I don give yu di gift to bi priest and anybody wey I nor choose, if e kom near di holy tin, dem must kill-am.”