Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 5:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Di High Priest fit sorry for doz wey sin, bikos dem nor know wetin dem suppose know, since en ensef dey sin too.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 5:2
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem kwik-kwik turn komot from di way wey I kommand dem o-o! Dem melt gold take make melu for demsef and dem don dey bow and offa sakrifice to am sey, ‘Israel pipol, dis na awa god wey take us komot from Egypt.’ ”


Doz wey dey foolish go undastand well and pipol wey dey always komplain, go get wisdom.”


“Nor do good again, but make yu kom join us. Make yu nor tell us about di Holy One for Israel again.”


But Simon, I don pray for yu make yor faith nor for fail. Wen yu don turn back kom meet God, make yu help yor brodas too.”


If I go must boast, den I go boast about di tins wey show sey I dey weak.


Na dat pesin make mi dey boast and I nor go boast about mysef, escept di tins wey show sey, I nor dey strong.


But wen I first prish di gospel give una, una know sey I nor well,


Dia mind dey for darkness and dem nor get part for di life wey God dey give, bikos dem sturbon and nor fit undastand.


e si mi as good pesin kon choose mi to serve am. But God sorry for mi, bikos den I nor know wetin I dey do and I nor bilive en gospel.


And make una waka for strait road, so dat una leg wey don taya, go strong.


So God make Christ like us wey bi en brodas and sistas. Like dis, Christ go sorry for us kon bi awa good High Priest. And bikos Christ dey koncern about God matter, e sakrifice ensef to remove awa sins.


Bikos Jesus sofa and devil tempt am, e don get pawa to save pipol wey devil dey tempt.


Dis awa High Priest undastand us wen wi dey weak, bikos all dis temptashon wey wi dey face so, e face dem too, but e nor sin.


Moses Law choose human being wey get weakness as High Priest, but God promise wey kom afta di law, choose di pikin and na-im bi di korrect Priest forever.


But na only di High Priest dey enter di Holy Place wons a year. For der, e go first offa blood for en sins, before e go offa for di pipol own, bikos dem nor know wetin dem suppose to know.


My brodas and sistas, if anybody among una waka komot from di trut and pesin bring am kom back,


Before-before, una waka komot for di rite road like sheep wey lost, but naw, una don turn back go meet di Shepad and Pesin wey dey guide una soul.


But dem nor still listin to di leaders, instead dem still dey serve and woship oda gods and dem nor do like dia grand-grand papa wey obey all God kommand.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ