“Oga, I tok to mysef sey yor promise go make mi dey save, bikos di king bi like God angel wey know good from bad. Make God wey bi yor God dey with yu!”
Just as apple tree dey among oda trees for forest, na so my love bi among di yong men. I dey like sidan for where e dey and en fruit dey sweet mi to chop.
E don rish wen wi go stop to learn only di first tins wey Christ tell us, so make wi dey grow kon know Christ more-more. Wi nor nid to still dey tish una about tins wey dey kause deat; why wi must bilive God;