For dat time, Jesus kon sey, “I praiz yu Papa, Oga God wey get heaven and eart, bikos yu hide dis tins from pipol wey get sense and doz wey know book well-well, but yu show dem to small shidren.
My brodas and sistas, make una stop to tink like small shidren. Instead make una dey tink like mature pipol and dey innocent like pikin wey dem just born.
My brodas and sistas, wen I dey with una before, una dey bihave like pipol for dis world. Na dis make mi nor fit tok to una as pipol wey get God Spirit. Dat time, una faith for Christ bi like small pikin own.
So make wi nor bi like shidren wey breeze dey karry up-and-down; shidren wey dey follow yeye tins wey human being dey tish and na dis tins dem dey take deceive pipol.
Evry word wey dey Bible, kom from God and dem dey good to tish us di trut and to know di tins wey dey wrong for awa life. God word dey korrect us wen wi dey wrong and e dey tish us to do good tins,