10 God make Christ to bi High Priest like Melkizedek.
Melkizedek wey bi Salem king kon bring wine and bread kom out. (Dis Melkizedek na di Most High God priest.)
God don promise and E nor go break di vow wen E make sey: “Yu bi priest forever like Melkizedek.”
So God make Christ like us wey bi en brodas and sistas. Like dis, Christ go sorry for us kon bi awa good High Priest. And bikos Christ dey koncern about God matter, e sakrifice ensef to remove awa sins.
My brodas and sistas wey God choose, make una tink about dis Jesus wey God send kom and na-im bi di High Priest wey wi bilive.
Wi get many tins to tok about, but dem nor eazy to esplain, bikos una nor dey gri obey.
di place where Jesus don enter for us and don bikom High Priest forever, just as Melkizedek bi.