6 God promise sey wi go enter di place where en rest dey, yet doz wey first hear di message, nor enter, bikos dem disobey am.
Di pipol wey I choose go use una name as curse. Mi, God wey bi king, go kill una. But I go give new name to pipol wey obey mi.
I go strike dem with diziz kon distroy dem, den I go make anoda nashon thru yu and e go dey great and mighty pass dem!”
Una sey dem go katch una shidren, but I go take dem go di land wey una rijet and e go bi dia own.
“Na dis make mi tell una sey, ‘Dem go take God Kingdom from una and dem go gi-am to pipol wey go bear di kind fruit wey E wont.’
“So make una know sey, dis salvashon wey God bring, dem don karry am go meet Gentile pipol, bikos dem go asept am!”
My friends, wetin I mean bi sey Christ go soon kom and e nor matter if yu don marry or not.
Dem rite for God word before sey, “E go asept Gentile pipol, wen dem get faith” and na dis make am tell Abraham before di time rish sey, “E go bless evribody, bikos of am.”
So make wi try well-well, so dat wi go enter dat place where rest dey and non of us go fall like di odas wey nor obey.
Bikos dem prish God word give us, just as dem prish am give dem too. But dem nor take am sirious, bikos wen dem hear am, dem nor gri bilive am.
So, di really “Sabat Day” rest, still dey kom for God pipol.