Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 4:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Nor-tin wey God kreate fit hide from am and evritin dey naked to God, bikos wi go must tell am how wi live awa life.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 4:13
37 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den e tell Solomon, “My pikin, I kommand yu sey make yu know yor papa God and make yu use all yor mind and heart take serve am. E know all wetin wi dey tink and wetin wi wont. If yu go meet am, E go take yu, but if yu turn from am, E go abandon yu forever.


E klear sey na God dey wosh di whole world and E dey ready to give pawa to doz wey trust am. Yu nor use sense for dis matter, so from naw go, na so-so war yu go dey fight.”


make Yu listin to dem from heaven; forgive dia sin kon ansa each pesin akordin to wetin Yu tink sey dey en mind. (True-true, na only Yu fit really know wetin pesin dey tink.)


Where dead body dey stay just dey open before God; nor-tin fit kover am from en eye.


God dey si evritin wey wi dey do. E dey si evry step wey wi take.


Anybody don ever show yu di gate wey dey guide where dead body dey?


My God, Yu know wetin I won tok even before I tok am.


E go know, bikos E know wetin dey evribody mind.


Make Yu stop di bad tins wey wiked pipol dey do kon defend doz wey dey good, bikos my God wey dey good, know wetin dey pipol mind and heart.


Yu know all di sins wey wi kommit; even di sins wey wi hide do, Yu dey si all of dem.


Even Deat and Distroshon nor get sekret for where God dey, tok-less of human being heart!


God dey wosh evriwhere, E dey wosh both good and wiked pipol.


God dey si evritin wey yu dey do and E know evriwhere wey yu dey go.


For evritin wey wi dey do, make wi know sey God go judge us; even di ones wey wi do for sekret, weda dem dey good or bad.


Bikos I dey si evritin wey dem dey do; dia wikedness nor hide from mi and e nor get where dem hide dia sin put wey I nor go si am.


Na mi wey bi God dey si and test human being heart. I dey trit each pesin akordin to how e dey live en life and wetin e dey do.


E nor get where pesin go hide put make I for nor si am. Yu nor know sey I dey evriwhere for di heavens and di eart?


Dis na wetin go happen to dem, bikos dem sin: dem sleep with dia neighbour wife kon lie with God name. God nor like all dis tins. E know wetin dem don do and wetin dem do dey stand against dem.” Dis na wetin God tok.


All di sekret tins wey dem hide, E dey bring am out; E know wetin dem hide for darkness and na lite E take kover ensef.


So dat una gift, go dey sekret and una Papa wey dey si for sekret, go reward una.”


But Jesus nor gri open en mind give di pipol, bikos e know dem well-well.


Jesus ask am di third time, “Simon, John pikin, yu sure sey yu love mi so?” Pita kon dey vex, bikos e pain am well-well, as Jesus ask am di same kweshon three times, “Yu sure sey yu love mi so?” Den Pita sey, “Oga God, yu know evritin, yu know sey I really love yu.” So, Jesus tell am, “Make yu feed my sheep.


Jesus tell am, “Go koll yor husband, make two of una kom meet mi.”


bikos E don choose one day wey E go take judge di world with raitiousness thru di man wey E choose and show evribody wen E raiz am from deat.”


So just as I prish give una, na so e go bi for dat day, wen God go judge all di sekret tins wey dey pipol heart thru Jesus Christ wey bi en pikin.


So, make una nor judge anybody until Christ go kom back. E go espose evritin wey dey darkness and di tins wey dey inside pesin heart. Dat time, na God go praiz evribody akordin to wetin dem do.


Bikos all of us must stand for Christ front and e go judge us akordin to di tins wey wi do wen wi dey dis eart; weda dem good or bad.


I go kill all en shidren, den all di church pipol go know sey, I know wetin dey for pipol mind and heart. I go reward evribody akordin to wetin e do.


But God tell Samuel, “Make yu nor happy, bikos of how en face look, bikos nor bi en I choose. God nor dey si tins di way una dey si am. Pipol dey look pipol from how dem bi for outside, but God dey look pipol from how dem bi for dia heart.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ