Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.
Den I hear one vois from heaven dey sey, “Make yu rite dis tins: “God don bless pipol wey bilive and obey Christ before dem die!” Di Spirit sey, “Blessing go really follow dis pipol and dem go rest from dia hard work, bikos of di good wey dem do.”
Den dem give each of dem long white klot kon sey, make una rest small until di oda savants and una brodas for Christ wey wiked pipol go kill, don komplete.