Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 3:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Na who make God vex well-well for forty years? Nor bi doz sinnas wey dia dead body skata for wildaness?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 3:17
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So, I vex for dem for forty years kon sey, ‘Dis pipol heart don turn from mi and dem nor gri do wetin I tell dem.’


Make una tell una dotas and neighbours wetin God tok: “Dead body go full evriwhere like manure wey dem skata for farm or korn wey dem gada for groun.”


non of dis pipol go dey alive to enter di land. Dem don si my glory and mirakle wey I do for Egypt and for di wildaness, but dem don too try my patient, bikos dem nor gri obey mi.


Make una tell dem sey, ‘As long as I dey, I go do anytin wey yu sey make I do. Na mi wey bi God tok am.


Una dead body go skata for dis wildaness, bikos una don komplain against mi. Nobody among una wey bi from twenty years go up, go enter di land.


doz men wey bring di evil ripot about di land, God kon kill dem with diziz.


So I won remind una even doh una don already know dis tins. Afta God don first save Israel pipol from Egypt, e kon distroy doz wey nor bilive am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ