Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 3:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Na who bi di pipol wey nor listin to God, even doh dem hear en vois? Nor bi pipol wey Moses lead kom out from Egypt?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 3:16
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yet dem still dey sin against am; dey disobey di Most High for di desert.


Dem sin against am many times for di wildaness kon make am vex for dat dry dirty land.


and burn am rish groun. Dem go burn am with di house where pipol for don make mi vex, bikos dem dey burn incense give Baal juju on-top di house and dey pour wine as ofrin give oda gods.


bikos dem sin kon make mi vex. Dem offa sakrifice kon dey serve oda gods wey dem or yu or dia grand-grand papa nor ever woship.


Why una dey woship juju and sakrifice give Egypt gods? Na bikos una dey stay der? Abi una nor know sey una dey make mi vex? Una dey distroy unasef and na dis make all di nashons for di eart dey trit una anyhow kon use una name as curse!


Den God tell Moses, “How long my pipol go rijet mi? Dem nor go ever bilive mi, even afta all di signs wey I don do for dia present?


Israel pipol kon bigin komplain against Moses and Aaron sey, “E for betta sey wi die for Egypt or for di wildaness!


But bikos my savant Kaleb nor bihave like di oda men and bikos e obey mi, I go take am go di land wey e go spy and en shidren-shidren go stay der.


I promise sey I go give Israel pipol di land, but una nor go enter der, apart from Kaleb and Joshua.


And out of di twelf pipol wey Moses send go shek di land, na only Joshua and Kaleb, remain.


So dem kon dey tell demsef sey, “Make wi choose new leader wey go take us go Egypt back!”


God don tok about dem sey, “Dem go must die for di wildaness.” And nobody among dem go remain, escept Kaleb wey Jefunneh born and Joshua wey Nun born.


But na Nun pikin Joshua wey dey assist yu go enter. So make Yu enkourage am, bikos na en go lead Israel pipol enter di land.


So I won remind una even doh una don already know dis tins. Afta God don first save Israel pipol from Egypt, e kon distroy doz wey nor bilive am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ