Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 2:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Instead, David tok for God word sey: “Wetin human being bi wey make yu dey kare for am and who bi yor pikin wey yu dey kare for like dis?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 2:6
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den Josef tell en brodas, “Na die I dey so. But God go true-true kom meet and take una go di land wey E promise sey E go give Abraham, Isaak and Jakob.”


Any human being fit dey klean? Anybody fit dey rite before God?


Tok-less of human being wey just bi like worm and magot! Wetin dia life mean to God?”


My God, na who wi bi wey Yu dey kare for us like dis? Na ordinary human being Yu dey kare for so?


All di nashons nor mean anytin to am at-all. For God eye, dem nor mean anytin at-all.


God sey, “Na mi dey give una pawa. So why una dey fear ordinary men wey nor go last pass grass?


“Make wi praiz Israel God, bikos E don help and free en pipol.


Since God love and en kindness strong well-well, E go let en salvashon rish us,


Fear katch all of dem and dem kon dey praiz God sey, “Na big profet kom meet us so-o!” and “God don kom help en pipol!”


Make nobody shit en Christian broda or make am vex, bikos na God go fight for di pesin wey yu shit and wi don tell una before and wi still dey warn una sey, God go really ponish pipol wey dey do like dat.


Wi know sey God ready and dey wait, bikos Bible sey, “Afta God don kreate evritin finish, E kon rest for di sevent day.”


God still sey, “Yu bi priest forever as Melkizedek bi.”


Dem one know di time and di pesin wey God Spirit dey tok about. God don tok before about di sofa wey E sey Christ must sofa and di glory wey e go get.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ