Make Yu nor rijet mi. Nor vex push yor savant komot from yor present, bikos na Yu dey diliver mi. So, make Yu nor leave or abandon mi, bikos na Yu dey fight for mi.
So make una nor fear, bikos I dey with una! Na mi bi una God, so make anytin nor make una fear! I go make una strong kon help una and I go protet and save una.
God sey, “Israel pipol, as una small and dey weak rish, make una nor fear, bikos I go help una. Mi wey bi Israel God wey dey holy, na mi bi di only Pesin wey go save una.
Israel pipol, si as una dey happy! Who bi like una? Una bi pipol wey God diliver, bikos na God dey protet una and na-im bi una swod. Make una enemies kry before una and una go mash dia back pass.”
E tell am, “Make yu nor fear, bikos my papa hand nor go fit tosh yu at-all. Yu go rule Israel and I go dey by yor side. Even my papa know sey na so e go bi.”