Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 13:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Make una nor forget to do good and to share wetin una get with each oda, bikos doz kind sakrifice, dey make belle sweet God.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 13:16
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make yu trust God and do wetin dey good, den yu go get peace for di land and yu go prosper.


Den Yu go asept di sakrifice wey dem go offa with betta spirit; di burnt and di full ofrins. Den pipol go offa melu as sakrifice, for yor altar again.


Wen Jesus hear wetin di man tok, e kon tell am, “E still get one tin wey yu neva do, make yu sell evritin wey yu get, give di money to poor pipol, den yu go get betta propaty for heaven. Afta dat, make yu kom follow mi.”


Jesus Christ wey kom from Nazaret, na-im God give di Holy Spirit and pawa. Una still know how e do good for evriwhere kon heal pipol wey devil dey opress, bikos God dey with am.


One woman dey for Joppa wey bi Jesus Christ disciple and en name na Tabita (wey mean Dorkas for Greek language). E dey do good tins and dey help poor pipol.


Make una give food to God pipol wey dey hongry and make una dey welkom dem for una house.


So anytime wey wi get shance, make wi dey do good, especially to pipol wey bi God shidren.


Di pesin wey dem dey tish God word, must share di good tins wey e get with di pesin wey dey tish am.


Pesin wey dey tif, make e nor tif again. Instead, make e work hard and do good with en own hand, so dat e go fit give pipol wey nor get.


But una try well-well as una help mi wen I dey trobol.


Naw, I get evritin wey I nid, bikos Epafroditus don give mi di tins wey una send. And na dis bi di ofrins wey dey make belle sweet God.


Make una dey sure sey nobody pay bad for bad, but for evritime, make una always dey do good for each oda and for evribody.


My brodas and sistas, make e nor taya una to do good.


Tell dem sey, make dem use dia money take do good. Make dem dey do plenty good works kon dey give doz wey nor get and make dem always dey ready to share with odas.


so I dey pray sey di faith wey yu get go make yu undastand all di blessings wey bi yor own inside Christ.


God nor dey support pipol anyhow. E go remember how una help en pipol before-before and how una still dey help dem naw. Una bi God pipol and E nor go forget di love wey una show en shidren.


My friend, make yu nor follow bad tin, but do wetin dey good. Di pesin wey dey do good, na God own and di pesin wey dey do wetin bad, neva know God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ