Wen Moses don tell Israel pipol evritin finish, dem take di man go outside di kamp kon stone am die. Like dis, Israel pipol kon do as God kommand Moses.
Wen dem don drag am go outside for di temple, dem kon start to dey stone am, den dem kon pul all dia klot give one man wey dem dey koll Saul, make e whole.
If pipol wey nor dey obey Man Pikin; dey take di kovenant blood make yeye and dey curse di Spirit wey bring grace, na how dia own ponishment go big rish?
True-true, Jesus make pipol dey holy, so en and di pipol wey e make holy, na God kreate dem. Na dis make am nor dey shame to koll dem en brodas and sistas.
Den Joshua and Israel pipol take Akan, Zera pikin with di klot, di silva, di gold, en shidren, melu, donkey, sheep, tent and evritin wey bi en own go Akor Valley (wey mean Wahala Valley).
Den, dem press di grapes for outside di town and blood rush kom out from di place where dem dey press dem. Di blood high rish five fit and e nearly rush rish two hundred mile.