Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 12:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Bikos na di pesin wey God love, na-im E dey korrect and E dey ponish all di shidren wey bi en own.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 12:6
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go bi en papa and e go bi my pikin. Wen e do wrong, I go ponish am as papa dey ponish pikin.


My pains dey good for mi, bikos e dey tish mi how to listin to yor kommand.


My God, I know sey yor laws nor dey bad or hard. Yu dey ponish mi, bikos e dey good for mi.


So Oga God, make di pipol wey Yu dey ponish, happy. Doz wey Yu dey tish yor ways.


Doz wey nor dey korrect dia shidren, hate dem. But doz wey love dia shidren, dey always korrect dem with love.


My pikin, if God korrect yu, listin well and take am as warnin.


Bikos God dey korrect only di pipol wey E love, just as papa dey korrect di pikin wey e dey proud of.


So like dis, God go forgive Jakob shidren and na like dat dem go take show sey dem nor go sin again. Dem go skata all di stone for dia juju altars kon distroy Asherah juju and all di incense altars.


Abeg God, make Yu korrect wi wey bi yor pipol. Make Yu nor ponish us bikos Yu dey vex, if not, all of us go die finish.


Den, why wi human being go dey komplain if dem ponish us for awa sins?


Make una tink am well. Just as papa and mama dey ponish dia pikin, na so too di Oga una God ponish una for una own good.


Di pesin wey fit bear wen problem kom meet am, make e happy, bikos e don show sey en faith strong and e go get di crown wey get life, wey God don promise sey E go give pipol wey love am.


Make una tink of how wi dey look pipol wey get patient sey, God don bless dem. Una hear how Job get patient and how God bless am leta. God get mesi and E dey sorry for pesin well-well.


I dey korrect and ponish anybody wey I love. So make yu dey sirious kon turn from sin kom meet God!


Afta sometaim, Naomi husband, Elimelek kon die leave di woman and en two pikin.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ