For morning for di third day, tonda, lite and one tick kloud kon appear on-top di mountin, so dem blow di horn well-well. Fear katch all di pipol for di kamp.
Pipol wey dey under di law and dem nor dey do evritin wey di law tok, dey under curse, bikos dem rite am sey, “E nor go betta for anybody wey nor dey do evritin wey dey di law.”
“God kom from Mount Sinai and E show ensef to Israel pipol for Seir; E shine kom from Mount Paran and E kom with 10,000 holy ones. Na en rite hand E take give dem en law.