Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 12:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Make wi dey look Jesus Christ wey give us awa faith and go help us keep am. Bikos of di joy wey Jesus dey espect, e sofa for cross and nor mind di shame wey follow am. But naw, e don sidan for di rite hand side for God throne.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 12:2
78 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di OGA tell my Oga God, “Make Yu sidan for where honor dey for my rite hand, until I don put all yor enemies under yor leg.”


God go fight for mi. My Oga God, yor love wey nor dey fail, go dey forever, so make Yu nor rijet di pipol wey Yu kreate by yorsef.


Pipol wey dey go Egypt for help, curse dey dia head! Dem dey put dia hope for di plenty sojas, ordinary horse and shariot wey Egypt get. But dem nor trust Israel God or kom meet am make E help dem!


Make evribody for di world turn kom meet mi naw and una go dey save, bikos na mi bi di only God wey dey.


Pipol rijet am and dem nor like am at-all. E bear sofa and pain well-well. Nobody even sorry am and wi trit am like sey e nor mean anytin.


I go really wait for God wey don rijet Jakob family; I go wait for am.


But as for mi, I bilive sey God go kom help mi. I dey wait for God with all my heart, so dat E go save mi. Yes! My God go hear mi.


“Den I go pour my spirit to pray and to show mesi for David shidren-shidren body and di oda pipol for Jerusalem. Dem go dey look mi, di pesin wey dem shuk, den dem go mourn like pesin wey dey mourn en only pikin. Dem go kry well-well like sey na dia first boy pikin die.


So Moses make snake with bronze kon put am on-top pole, so dat di pipol wey snake bite, if dem look di snake wey dem make with bronze, dem nor go die.


From dat time go, Jesus kon dey tell en disciples sey, e go must enter Jerusalem where di eldas, priest oga dem and di law tishas go sofa and kill-am, but for di third day, e go wake-up.


just as Man Pikin nor kom make pipol serve am, but make e for serve and give en life to save many pipol.”


Jesus kon pray, “My Papa, e nor get wetin yu nor fit do. Make yu take dis sofa cup from mi. But nor bi as I wont am, but na as yu wont.”


Wetin dem rite for God word kon happen sey, “Dem kount Jesus join bad pipol.”


Afta Jesus don tok to dem finish, God kon karry am go heaven and e sidan for God rite side.


Jesus ansa dem, “True-true, Elijah go first kom, make e for prepare evritin. Naim make dem rite for God word sey, ‘Man Pikin must sofa many tins and dem must hate am?’


Kwik-kwik di boy papa kon shaut, “I bilive o-o! Help mi make I bilive more-more!”


Di disciples kon tell Jesus, “Wi beg! Make yu make awa faith strong.”


Herod with en sojas too dey take Jesus make yeye and dey laf am. Den Herod sey make dem wear fine klot for Jesus body, den make dem take am go back go meet Pilate.


Dem nor tok sey di Mezaya go must sofa all dis tins and den e go enter en glory?”


Wen day break, John si Jesus dey waka kom meet am, den John sey, “Make una look! Dis na di Sheep wey God send kom die, so dat God go forgive us awa sins.”


I tell una true word, if one korn seed fall for groun and e nor die, e nor go grow, but if e die, e go grow kon bear plenty seed.


But as for mi, if una karry mi go up for cross, I go draw evribody kom meet mi.”


Bikos Jesus know sey en Papa don gi-am pawa to kontrol evritin and as e bi sey e kom from God and e dey go back go meet am,


Wetin my Papa wont bi sey, anybody wey bilive en pikin, go get life wey nor dey end and I go wake am up for di last day.”


Una papa Abraham happy well-well wen e hear sey I dey kom. E si am and e happy well-well.”


So Israel pipol, make una know sey, God don turn dis Jesus Christ wey una kill, to bi Oga God and Mezaya.”


Una kill di pesin wey dey give pipol life, but God raiz am from deat and wi bear witness sey dis na true.


But God don promote am sey make e sidan for en rite hand kon gi-am big pozishon as Oga God and di Pesin wey go save di world, so dat Israel shidren go turn from dia sin kom meet God make e forgive dem.


So di apostles komot from der dey happy well-well sey God don give dem di shance to sofa, bikos of Jesus Christ.


Di message about Christ deat for cross bi like foolish matter to pipol wey don lost, but for wi wey God don save, di message na God pawa.


but di true message about Jesus wey dem kill for cross, naim wi dey prish and di message bi like stone wey Jew pipol kick by mistake kon fall, but to Gentile pipol, na yeye tin e bi.


E use di sofa wey e sofa for cross take end dia kworel kon make dem one body as dem dey serve God.


Make wi love one anoda, just as Christ love and sakrifice ensef as ofrin wey get betta smell to God, bikos of us.


I dey sure sey, di Pesin wey start dis good work for una life, go make am pafet until di day wen Christ go kom.


But wi bilong to heaven and wi dey wait awa Savior wey kom from der, wey bi Oga God Jesus Christ.


Naw, di prize for raitiousness dey wait mi and na God wey dey judge rite go give mi dis prize for di day wen Christ go kom. Di prize nor bi for mi alone, but na for evribody wey dey wait for Christ to kom back.


Na wish angel God tell, “Sidan for my rite hand until I go put all yor enemies under yor leg?”


Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.


Na with one sakrifice e take klean pipol from dia sins and dem don dey klean forever.


Dat time, some pipol curse and sofa una and for oda times, una dey help odas wey dey sofa like una too.


Pipol laf some; flog some; shain some and put odas for prison.


If una dey tink how Jesus sofa for wiked pipol hand and how dem hate am, una mind go strong for faith.


Wi must go meet am for outside di kamp kon share di shame with am.


Wen God don make Christ pafet finish, e kon save evribody wey obey am.


bikos di law nor fit make anytin dey pafet. But naw, wi get betta hope wey go draw us near God.


Wetin I mean bi sey: Wi get High Priest wey sidan for God rite hand side for heaven.


na so too Christ die wons, as sakrifice to forgive pipol forever and naw, e go bring salvashon to doz wey dey wait for am.


My brodas and sistas, since una get faith for awa Oga God Jesus Christ, make una nor dey do parsha.


Dem one know di time and di pesin wey God Spirit dey tok about. God don tok before about di sofa wey E sey Christ must sofa and di glory wey e go get.


Bikos of sin, Christ sofa. En wey nor do bad, sofa for doz wey do bad, so dat e go karry us go meet God. And wen dem kill-am, e wake-up as spirit.


go heaven kon go sidan for God rite hand, where e dey rule di angels and doz wey get pawa.


Make una keep unasef inside God love as una dey wait for awa Oga God Jesus Christ, wey go bring life wey nor go end.


“Make yu rite evritin wey yu dey si inside dis book, den send dem go meet di pipol wey dey di seven church wey dey for Efesus, Smyrna, Pergamum, Tiatira, Sardis, Filadelfia and Laodicea.”


Wen I si am, I fall near en leg like sey I don die. But E tosh mi with en rite hand, kon sey: “Nor fear! Na mi bi di First and di Last,


God sey, “Na mi bi di Alfa and Omega, di One wey dey since, wey dey naw and wey go still kom, na mi bi di God Almighty!”


“Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Smyrna: ‘Dis message na from di Pesin wey bi di First and di Last, di One wey die kon kom back to life.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ