10 Awa papa dey ponish us for dis world as e good for dia eye, but God dey ponish us for awa own good, so dat wi go follow am share en holiness.
My God, I know sey yor laws nor dey bad or hard. Yu dey ponish mi, bikos e dey good for mi.
Bikos I dey raitious, I go si Yu. Wen I don leave dis world kom meet Yu, I go si Yu face-to-face and belle go sweet mi.
God nor like to sofa pipol or make dem kry.
“Make yu tell Israel pipol sey, ‘Una must dey holy, bikos mi wey bi Oga una God, dey holy.
Den, true raitiousness and holiness wey di trut dey bring, make una wear di new man wey God don kreate like ensef.
But naw, with en pikin blood, E don draw una klose kom en present, so dat E go make una en friends wey nor get stain or fault and wey dey holy.
E die for us, so dat e go free and klean us from wikedness kon turn us to en own pipol wey like to do good tins.
Make una try to live for peace with evribody and dey holy, bikos anybody wey nor dey holy, nor go si God.
So unasef too, don bi stone wey dey alive and God dey build una as en spiritual house, so dat una go bi priest wey dey holy and una go offa spiritual sakrifice wey E go asept thru Jesus Christ.
But God don choose una to bi en priest and holy pipol, so dat una go prish di Good News, bikos E koll una from darkness kon enter en brite lite.
Like dis too, wi don get betta promise and bikos of dat, wi go get God karata wey go free us from di bad tins wey dey for dis world.
Afta sometaim, Naomi husband, Elimelek kon die leave di woman and en two pikin.