Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 11:32 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

32 Wetin I go tok again? I nor get time to tok about Gideon, Barak, Samson, Jeftah, David, Samuel and di profets,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 11:32
38 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Moses and Aaron dey among en priests; Samuel na one among di pipol wey pray to am. Dem pray to God and E ansa dem.


Den God tell mi, “Even if Moses and Samuel stand here dey beg for dis pipol, I nor go listin or sorry for dem. So make yu take dem komot for my front kon tell dem make dem dey go!


make una happy and make belle sweet una, bikos na big tin dey wait una for heaven. Make una remember sey, na so di profets wey kom before una, sofa too.”


“Una go kry dey grind tit wen una si Abraham, Isaak, Jakob and all di profets inside God Kingdom, but God go trow una for outside.


“Abraham ansa am, ‘If dem nor gri listin to Moses and di profets, dem nor go still listin, even if pesin wey don die go back go meet dem.’ ”


Jesus do many oda tins wey dem nor rite down. If to sey dem rite all of dem, di world nor go get space wey go kontain all di book, where dem rite dem put.


All di profets tok about am sey, ‘Evribody wey bilive am, thru en name, God go forgive dem.’ ”


All dis tins happen for four hundred and fifty years. Afta dis, E kon give dem profet wey go judge dem, until Profet Samuel time rish.


God don tok about all dis tins wey dey happen so, from Profet Samuel time go rish di profets wey kom afta am.


If God nor ponish us for di bad tins wey wi dey do, e mean sey God dey support us? No! So if God ponish us, wi go sey E dey wiked? (Na so some pipol dey tok).


Na wetin Abraham awa grand-grand papa learn from dis matter?


So wetin wi go tok? Make wi kontinue to dey sin so dat God grace go dey with us?


Dis mean sey di law nor good? No! But na di law make mi know wetin sin bi. If to sey di law nor sey, “Nor get long-trot for anoda man tin,” I nor for know sey I nor suppose to do dat kind tin.


Di profets wey God send kom tok to una, make una use dem as ezample to bear sofa and get patient.


bikos know profesy don ever kom out from human being mind. Instead, na di Holy Spirit dey kontrol di pipol wey dey tok God word.


I wont make una remember all di word wey di profets tok before and di kommandment wey awa Oga God and Savior give us thru di apostles.


So wen di woman born, e kon koll di pikin, “Samson.” Di pikin grow well and God kon bless am.


Samson lead Israel pipol for twenty years, even doh Filistia pipol still dey rule di land.


Afta Ehud die, Israel pipol sin against God again.


Israel pipol sin against God again, so E allow Midian pipol rule dem for seven years.


Den God angel kom Ofrah village kon sidan under di oak tree, wey bi Joash wey kom from Abiezer family, own. Den, en pikin Gideon dey hide pick wheat for one wine press, so dat Midian pipol nor go si am.


Den God angel turn kon tell am, “Make yu go with di pawa wey yu get kon save Israel pipol from Midian pipol, bikos na mi dey send yu!”


Afta sometaim, Hannah get belle kon born boy. Den Hannah koll am, Samuel, bikos e sey, “I ask God make E gi-am to mi.”


So, God send Jerub-Baal, Barak, Jeftah and Samuel and E kon save una from una enemies.


God tell Samuel, “Na how long yu won to dey sorry for Saul? I don rijet am as Israel king. So put olive oil for yor horn make yu dey go. I dey send yu go meet Jesse for Betlehem, bikos I don choose my king from among en sons.”


So Samuel take di horn wey olive oil full kon anoint di boy for en brodas front. God Spirit kon enter David body from dat day go. Den Samuel kon go Rama.


But David ansa am, “Yu dey kom meet mi with swod, spear and javelin. But I dey kom meet yu with di name of di Oga wey bi God of all ogas; Israel sojas God wey yu dey shalenge.


Den, Elkanah and en family kon go back to Rama. But Samuel stay for Shiloh dey serve God with Eli wey bi di priest.


Naw, Samuel dey serve for God house. Di boy wear klean linen klot.


Sojas swod don break to pieces, but doz wey dey weak, God dey make dem strong again.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ