31 Na faith make Rahab, wey bi ashawo, eskape wen God distroy pipol wey nor obey am, bikos e welkom di pipol wey kom spy.
Jesus Christ wey dem born for David and Abraham family, naim story bi dis.
Salmon born Boaz (wey Rahab bi en mama), na Boaz bi Obed papa (wey Rut bi en mama), Obed kon born Jesse,
Afta dem don stay der tey small, di brodas kon send dem back with peace to di pipol wey send dem kom.
Na who God swear for sey, dem nor go ever get rest, nor bi doz wey disobey am?
Nor bi so e bi for Rahab, wey bi ashawo, wen e welkom di messenjas kon show dem anoda road wey dem go pass run?
Afta Moses, God savant don die, God kon tell Joshua wey bi Nun pikin wey bin dey help Moses sey,
Na-im bi di rock wey dey fall pipol, bikos dem nor fit jump am pass. As dem nor bilive God word, dem bigin fall, bikos na so E plan sey e go bi.
bikos dem nor do wetin God tok. God get patient for dem wen Noah dey build di ark, but na only di eight pipol wey dey inside di ark save from di wota.