Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 11:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 Na di same faith make Moses komot from Egypt and e nor fear di king vexnashon, bikos e get hope for God wey ordinary eye nor fit si.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 11:27
27 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I don make God nomba one for evritin wey I dey do and bikos E dey for my rite side, I nor go shake or fear anytin.


All dis yor savants go kom meet and bow for mi sey, ‘Make yu and all di pipol wey dey follow yu komot for here’ and afta dis, I go komot for here too.” With vexnashon, Moses kon waka leave Fero.


“ ‘Na like dis una go take chop am: make una dress like who dey travel; wear una shoe kon hold una stik for hand. Make una rush chop am, bikos dis na Oga God Passova.


So Israel pipol kon do as Moses and Aaron kommand dem.


God tell Moses for Midian, “Make yu go Egypt back, bikos all di pipol wey get mind to kill yu, don die.”


Evribody go hate una bikos of mi. But anybody wey fit bear rish di end, God go save am.


But God go save di pesin wey go bear go rish end.


Evribody go hate una bikos of my name. But di pesin wey go fit bear rish end, go dey save.”


and bikos dem nor get rut and patient, wen trobol or wahala kom bikos of di word, dem go forget God word.


Dis na wetin David tok about sey, “ ‘God always dey near mi and bikos e dey for my rite hand, I nor go fear anytin.


Love dey bear evritin and e get faith, hope and patient.


Wi nor dey look for wetin eye fit si, but na wetin eye nor fit si. Bikos wetin eye fit si nor go last, but di tins wey eye nor fit si, dey last forever.


God wey wi nor dey si, na Jesus bi en image and for evritin wey E kreate, na Jesus bi di first.


Make all di honor and glory bi God own forever and ever! Na-im bi di King wey nor dey die, di One wey nobody dey si and na only en bi God. Amen!


Dis God nor fit die and E dey stay for lite wey nobody fit waka near. Lite wey human being neva fit si. Make all honor and pawa bi en own forever and ever. Amen!


But make una remember how tins bi with una before, how una dey sofa afta una don receive God lite, yet una nor allow di sofa shange una mind.


Faith na wen wi dey sure sey wetin wi dey hope for go happen and wi sure sey, di tins wey wi neva si, go kom.


All of dem faith still strong wen dem die and dem nor get di tins wey God promise dem, but dem si and welkom di tins from far and dem gri sey, dem diasef na strenja for dis world.


Bikos Abraham get patient, God kon gi-am wetin E promise am.


Make una tink of how wi dey look pipol wey get patient sey, God don bless dem. Una hear how Job get patient and how God bless am leta. God get mesi and E dey sorry for pesin well-well.


Aldo una neva si am, but una love am. Una nor dey si am naw, but una bilive am, una get happiness and glory wey una nor go fit esplain.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ