Wi nor dey look for wetin eye fit si, but na wetin eye nor fit si. Bikos wetin eye fit si nor go last, but di tins wey eye nor fit si, dey last forever.
All of dem faith still strong wen dem die and dem nor get di tins wey God promise dem, but dem si and welkom di tins from far and dem gri sey, dem diasef na strenja for dis world.
But as tins bi so, dem dey espect kountry wey betta pass dia own and e dey kom from heaven. Naim make God nor shame wen dem dey koll am dia God, bikos E don build big town for dem.