“Evritin wey I don tell yu about Israel, Judah and all di nashon, make yu go rite dem put for one book. Yu go rite evritin wey I tell yu from di first time wey I tok to yu, afta Josaya just bi king kon rish naw.
I nor go fit do anytin with my own pawa, but na wetin I dey hear from my Papa, naim I dey use take judge. Any judgement wey I give, na true one, bikos I nor dey do my own tin, but I only dey do as my Papa send mi.