6 since yu nor like animal blood as ofrin for sins again.
No! But God dey happy for pipol wey dey fear and obey am; doz wey put dia hope for en love wey nor dey fail.
Yu really don make mi undastand sey, nor bi only sakrifice and ofrin yu wont. True-true, Yu nor just wont only burnt or sin ofrin.
God sey, “I wish sey one of una go klose di temple door, so dat una nor go dey burn yuzles fire for my altar. I nor dey happy with una and I nor go asept di sakrifice wey una dey bring kom give mi.”
Naim one vois from heaven kon sey, “Dis na My pikin wey I love and e dey make belle sweet mi.”
Make wi love one anoda, just as Christ love and sakrifice ensef as ofrin wey get betta smell to God, bikos of us.
Naw, I get evritin wey I nid, bikos Epafroditus don give mi di tins wey una send. And na dis bi di ofrins wey dey make belle sweet God.
since melu and goat blood nor fit really klean pesin from all en sins.
Den Samuel sey, “Na wish one God like pass: to obey am or to offa ofrin and sakrifice? E betta to obey dan to sakrifice di best sheep gi-am.