Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 10:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 since melu and goat blood nor fit really klean pesin from all en sins.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 10:4
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Nor bi sakrifice or burnt ofrin yu wont, if not, I for offa sometin give Yu.


Wiked pipol dey do tins for God like sey dem dey do am give juju and dis kind tin dey make God vex for dem. Weda dem kill melu as sakrifice, dem go dey guilty like sey dem kill human being. Even if dem sakrifice lamb, e go bi like sey na dog dem sakrifice; even if na rice dem present, dem go dey guilty like sey dem offa pig blood as ofrin; or if dem offa incense give God, dem go still dey guilty like who offa am give juju, bikos dis pipol don choose dia own way and dem like di yeye tins wey dem dey do.


Dia gift wey dem dey bring from Sheba or di incense wey dem bring from far land nor mean anytin to mi. I nor go fit asept dia ofrin again and dia sakrifice nor fit make belle sweet mi.’


Make una turn kom meet God and pray to am sey: “Make Yu forgive us awa sin kon asept awa prayers, so dat wi go praiz Yu.


Nor bi animals sakrifice I wont, but na una love wey nor dey die. E betta make my pipol know mi, dan all di burnt ofrin wey dem dey give mi.


To love God with all awa heart, mind and pawa and to love awa neighbour as awasef big pass all di sakrifice and ofrins wey pesin fit give God.”


Wen day break, John si Jesus dey waka kom meet am, den John sey, “Make una look! Dis na di Sheep wey God send kom die, so dat God go forgive us awa sins.”


And na dis go bi my agriment with dem wen I don forgive dem dia sins.”


Moses Law bi like shadow wey dey show good tins wey dey kom. Di shadow nor bi di tins, bikos di sakrifice wey dem dey offa evry year nor fit forgive pipol dia sins.


Before-before, di priest dey serve evriday and dey offa di same sakrifice wey nor fit remove sin.


Christ first sey, “Yu nor wont animal or sin ofrin, (even wen dem dey offa am akordin to di law).”


Dis na sign make wi for fit undastand sey: Di gifts and sakrifice wey di priests dey offa for God pipol, nor fit make dia mind klean.


And una know sey God send Jesus kom, make e for karry sin komot and know sin dey inside Christ.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ