God sey, “Na my savant wey I give pawa bi dis; di pesin wey I choose and I dey happy with am. I don put my Spirit inside am and e go judge di nashons well.
“But if one good man stop to do good kon dey do bad and wiked tins wey bad pipol dey do, yu tink sey e go live? No! Dem nor go remember any good tin wey e do. E go die, bikos e nor gri obey my law and e dey sin.
“If betta pesin kon start to do wiked tins and I kause wahala for am, e go die if yu nor warn am. E go die bikos of en sins; I nor go remember di good tins wey e do and I go whole yu for en deat.
I fit promise good man good life, but if e bigin tink sey di good wey e do before go save am, den e start to sin, I nor go remember all di good wey e do. E go die, bikos of en sins.
God sey, “I wish sey one of una go klose di temple door, so dat una nor go dey burn yuzles fire for my altar. I nor dey happy with una and I nor go asept di sakrifice wey una dey bring kom give mi.”
Bikos na di Gospel dey show how God dey take make pipol klean for en eye. From di biginnin go rish di end, God sey, “Na only faith go make pesin dey klean for my eye.”
Di same Jew pipol wey dey ponish us, na dem still kill awa Oga God Jesus Christ and di profets. Dem dey wiked to evribody and nor dey do wetin God wont.
Na from us dis pipol from komot, but dem nor really dey God family before, bikos if to sey dem dey, dem for stay with us. But dem live us, so dat evribody go know sey dem nor bi awa own.