So, make yu wait for God with patient! Make yu get mind as yu dey wait am! Make yu nor worry about wiked pipol wey dey prosper or fear, bikos of wetin dem get.
“Wish of di two shidren do wetin dia papa wont?” Dem ansa, “Na di first one.” Jesus kon tell dem, “I tell una true word, tax kollectors and ashawo dem go first una enter God Kingdom!
But di seeds wey fall for betta groun, na di pipol wey hear God word, hold am with betta mind, dey obey God and bear wahala, so dem kon bear plenty fruit.”
Afta God remove am, E kon make David dia king. Na dis man God tok about sey, ‘I don si David, Jesse pikin, di man wey I like well-well and e go do evritin wey I wont.’
Make una nor bi like pipol for di world, but make una allow God shange una mind, den una go know how to serve God and do tins wey dey make belle sweet am.
Make una nor bi like pipol wey dey do dia work wen dem si sey, pesin dey look dem; bikos dem dey fine good face. Instead, as una bi Christ savant, make una dey do wetin God like from una heart.
Epafras, wey bi one among una and Christ savant, dey greet una. E dey pray well-well for una, so dat una leg go strong for groun and una go grow as una dey learn di tins wey God wont.
Since wi get many witness wey surround us, e good make wi drop evry load and sin wey dey make us fall, so dat wi go use awa mind live di life wey God wont.
make E give una evritin wey una nid to do wetin E wont. Anytin wey good for en eye, make E do am inside us thru Jesus Christ. Make all glory bi Jesus Christ own forever and ever. Amen!
Na dis make am bi middo-man for di new kovenant, so dat pipol wey e koll go fit receive di propaty wey go dey forever. E promise us dis propaty, wen e die to free us from di bad-bad tins wey wi don do wen di first kovenant still dey.
Anybody wey dem suppose to katch, dem go katch am. Anybody wey swod go kill, dem go kill-am with swod. So, God pipol must bear well-well and get faith.