Wons evry year, Aaron go klean di altar with blood from di horn and dem go dey do like dis from one generashon go rish anoda, bikos e dey holy to Oga God.”
Dis na di law wey una go obey forever. Dem must do dis sakrifice wons for evry year to take santify Israel pipol from all dia sins.” So Moses do as God kommand am.
But na only di High Priest dey enter di Holy Place wons a year. For der, e go first offa blood for en sins, before e go offa for di pipol own, bikos dem nor know wetin dem suppose to know.