Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Hibru 10:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 So make wi whole di hope wey wi get strong well-well, bikos God wey promise us dey always keep en promise.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Hibru 10:23
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

My God, my hand klean and I trust Yu with all my heart, so make Yu show sey I dey innocent.


Wi dey always trust Yu bikos na evriday Yu dey show us yor goodness.


God dey faithful, bikos na-im koll una to waka with en pikin, Jesus Christ wey bi awa Oga God.


E nor get anytin wey dey happen to una naw, wey neva happen to odas before, but God dey keep en promise and E nor go allow una pass thru wetin una nor go fit bear.


Bikos of una work, pipol go praiz God, bikos una dey obey Christ word wey una bilive and una dey share evritin wey una get with good mind.


Di Pesin wey koll una to do en work dey faithful.


But Christ dey keep en promise and E go make una strong.


Di trut dey give dem di mind sey dem get life wey nor dey end and na God wey nor fit lie promise dem dis life even before E kreate di world.


Na faith make Abraham born, even doh Sarah don too old to get belle and Abraham don old too, but e know sey di Pesin wey promise am pikin, na Pesin wey e fit trust.


My brodas and sistas wey God choose, make una tink about dis Jesus wey God send kom and na-im bi di High Priest wey wi bilive.


Bikos wi go bi Jesus Christ friend, if wi whole awa faith strong go rish di end.


But as God Pikin, Jesus dey faithful for God house. So wi too go get share for di house if wi bilive and get konfident for awa hope wey dey inside Christ.


Jesus wey bi God Pikin, na-im bi awa High Priest wey don go heaven. Make wi hold am tait and always dey bilive am.


God nor dey lie! So di promise wey E make and ensef wey E take swear, na two tins wey nor go shange. Since wi don run go meet God make E guide us, e good make awa mind strong, so dat wi nor go fear as wi bilive en promise.


Di pesin wey dey ask, must get faith and make en mind nor shake, bikos anybody wey en mind dey shake, bi like river wey strong breeze dey blow up-and-down.


I go soon kom. Make yu whole wetin yu get well-well, so dat nobody go take yor crown from yu.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ