“Afta dat one, e go kill di goat for di sin ofrin for di pipol, take di blood go di place wey holy pass kon rub am for di plate and di Kovenant box front, just as e do di melu blood.
“Make yu tell yor broda Aaron sey, na di rite time e go-go di place wey holy well-well for di curtain back, bikos na for der I appear for kloud on-top di Kovenant Box. If e nor do am, e go die.
but e nor go enter di holy curtain or kom near di altar, bikos e get diziz. So e nor go offa dis tins, bikos na mi bi God and I don make dem dey holy.’ ”
E don kansol Jew pipol law with all en kommand and rules, so dat e go fit make Jew and Gentile pipol to bi one with am and like dis, peace go dey among dem.
Wi know sey God ways dey great well-well: Christ kom as human being; di Spirit show sey e dey free; angels si am wen e kom prish among Gentile pipol; pipol bilive am for di world and God karry am go heaven with glory.
Dis hope strong for awa heart like ship wey dem tie make e nor for move, bikos di hope wey wi get dey kamkpe and strong gidigba. Di promise go take us pass di curtain for heaven, until wi rish where God dey;
Bikos pipol wey dey deceive odas, don enter di world; dem nor gri sey Jesus Christ don kom dis world as human being before. Dis kind pipol dey deceive odas and na anti-Christ dem bi!