2 If pipol wey dey woship God don free from dia sins, dem nor for dey offa sakrifice again.
Just as east far from west, na so too E make awa sins far from us.
But na mi wey bi God still dey forgive una sins and I do all dis tins, bikos of who I bi! I nor go kount una sins against una.
I don remove una sins komot like sey na tick kloud. So make una turn kom meet mi, bikos na mi bi di Pesin wey save una.”
Yes! Yu go sorry for yor pipol. Awa sins go dey under yor leg and Yu go trow dem go under di sea!
God sey, “Bikos of di sakrifice and blood kovenant wey I make with una, I go free una pipol from slave work.
e kon sey, ‘I nor go remember dia sins and sturbones again.’ ”
If anybody bear pain bikos of God and dey sofa for wetin e nor do, God go favor am.