1 Moses Law bi like shadow wey dey show good tins wey dey kom. Di shadow nor bi di tins, bikos di sakrifice wey dem dey offa evry year nor fit forgive pipol dia sins.
Moses Law nor fit do dis tins, bikos di yeye life wey wi dey live don make di law weak. But God don free us wen E send en pikin kom like human being wey bi sina, make e for sakrifice ensef for awa sins.
Even doh Moses Law sey priest must kom from Levi family, dat kind priest nor fit make pesin dey pafet. So anoda priest like Melkizedek must kom and e nor bi like priest wey kom from Aaron family.
Di priest work for di temple bi like wetin dey happen for heaven. Bikos wen Moses dey one build God house, God tell am: “Make sure sey evritin bi like di design wey I show yu on-top di mountin.”
So Christ don bi High Priest for di good tins wey don kom. E don enter di Holy Place for heaven wey dey pafet. Nor bi human being make di place and e nor dey among tins wey God kreate for dis world.
Na dis make dem dey klean di Holy Place for dis eart with animal blood, bikos e bi like di one for heaven. But di tins wey dey for heaven, nid sakrifice wey betta pass dat one.