Dis na wetin God wey save una, di Pesin wey form una for una mama belle dey tok: “Na mi bi God wey kreate evritin. Na only mi stresh di heavens kom out kon design di eart as I wont.
Na mi bi di Pesin wey kreate di eart and na mi kreate di pipol wey dey stay inside. Na my pawa I take stresh di heavens out kon kontrol di sun, moon and di stars.
God wey kreate di heavens and di eart sey, na-im still bi God! Na mi kreate di eart well and I nor kreate am to dey empty, but na for pipol to stay. E sey, “Na mi bi God and e nor get anoda one.
En vexnashon nor go stop until E don do evritin wey E plan to do. Afta sometaim, en pipol go undastand all dis tins. One day, una go undastand wetin I mean.
Yu and yor pipol go attack my pipol like strong kloud wey dey pass di land. Wen di time don rish, I go send yu go skata my land, so dat dem go know who I bi and dem go si as I holy rish, bikos of di tins wey I go do thru yu.
But, e get one God wey dey for heaven wey dey open sekret and tell dreams. E don tell King Nebukadnezzar wetin go happen for future. Dis na di dream and vishon wey yu si:
But di time dey kom wen Israel pipol go turn kom meet Oga God and one among David shidren-shidren, go bi dia king. Den dem go fear God and E go bless dem.
For di last days, di mountin where God temple dey, na-im go high pass all di mountins. E go high pass di hills too and pipol from evry nashon go dey rush go der go woship God.
“But wen di farmers si di boy, dem kon tell each oda, ‘Di landlord pikin wey go inherit en papa propaty afta e don die, na-im dey kom so. Make wi kill-am and kollect wetin go bi en own.’
“Di man get one pikin wey e love well-well and na dis one remain for am to send. At last, e kon send am go meet dem dey tok for en mind sey, ‘As dis one bi my pikin, dem go respet am.’
Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world. Wi si en glory wey show sey, naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut, wey God send kom meet us.
I nor go koll una savant again, bikos savant nor dey undastand wetin en oga dey do, but I dey koll una my friend, bikos I don show una evritin wey I hear from my Papa.
“God love di pipol wey dey dis world well-well, so E kon send di only pikin wey E get to us, so dat anybody wey bilive am, nor go die, but e go get life wey nor dey end.
“ ‘Wen di last day don rish, God sey, “I go pour my Spirit inside evribody and all una shidren, both boys and girls go dey profesai, una yong men go dey si vishon and una old men go dey dream plenty dreams.
And if wi bi God shidren, den wi go inherit God propaty. Yes, wi go follow Christ inherit God propaty, bikos if really wi sofa with am, wi go follow am enjoy.
But wi (wey bi Christian), na only one God wi get and naim bi awa Papa. Na-im kreate evritin and wi dey live for am. Na Jesus Christ bi awa only Oga God. Na-im make evritin and na thru am wi get life.
Bikos I know sey wen I don die, una go spoil unasef kon turn from dis way wey I kommand una. Wahala go kom meet una dat time, bikos una don do bad tins wey go make God vex.”
But as God Pikin, Jesus dey faithful for God house. So wi too go get share for di house if wi bilive and get konfident for awa hope wey dey inside Christ.
Moses Law choose human being wey get weakness as High Priest, but God promise wey kom afta di law, choose di pikin and na-im bi di korrect Priest forever.
bikos if na so, Christ for dey kom die for us evry year since di time wey God kreate di world. But nor bi so! E die wons and for all, so dat awa sins go-go forever.