12 and like klot and koat, God go fold and shange dem, but God nor dey shange and en life nor go ever end.”
“Wi nor fit know how God strong rish. Wi nor fit search or kount how many years God don dey.
To Yu, one tazon years bi like one day or like some hours for nite.
God ansa, “I bi Who I bi. Dis na wetin yu go tell dem, ‘Na di God wey bi who E bi send mi kom meet una.’ ”
Dem skata where I dey stay won kon take my life like tent wey dem pul from groun; like klot wey dem kut komot from machine. Yes! I bin tink sey God won end my life.
Jesus ansa dem, “Na true word I dey tell una so, before dem born Abraham, I don already dey!”
Jesus Christ na di same yestiday, today and forever, e nor dey shange!
bikos evry betta and pafet gift dey kom from God. E dey kom down from di Papa wey kreate lite and E nor dey shange.