Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Haggai 2:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 For dat day, I go take yu, Zerubabel, Shealtiel pikin wey bi my savant kon make yu rule with my name, bikos na mi choose yu.” God wey get pawa don tok.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Haggai 2:23
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu really ansa awa prayers wen Yu show us how Yu take dey save and diliver us. Di whole eart trust Yu; plus pipol wey dey di oda side for di sea.


Make only mi dey yor heart and make I bi like betta ring for yor hand, bikos love strong like deat and feelins for pesin, bi like grave wey nor dey full. E bi like heavy fire and e dey katch well-well.


God sey, “Na my savant wey I give pawa bi dis; di pesin wey I choose and I dey happy with am. I don put my Spirit inside am and e go judge di nashons well.


Israel pipol, na una bi my witness. I choose una as my savants, so dat una go know, bilive and undastand sey na mi bi di only God. E nor get any oda god wey dey apart from mi. E neva dey before and e nor go ever dey.


Si, I don rite una names for my hand, una face go always dey my mind.


God sey, “As far as I bi di God wey dey alive, Jehoiakim pikin, Jekonaya wey bi king for Judah, yu nor go fit bi king for dis eart. I go take dat pawa komot from yor hand.


“Na my savant wey I choose bi dis, di One wey I love, wey I dey happy with. I go put my Spirit inside am and e go judge di world.


Make una nor work for food wey nor dey last, but for food wey go give una life wey nor dey end and dat kind food, na only Man Pikin go fit give una, bikos na-im God send kom.”


But God strong foundashon still stand and dem rite put sey, “God know en pipol and evribody wey bi Christ own, must stop to do evil.”


Una don kom meet Christ, wey bi di stone wey dey alive. Pipol rijet am, but God choose am and e dey important for God eye.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ