Wen Zerubabel, Shealtiel pikin and Jeshua wey Jozadak born hear dia message, dem kon start to ribuild di temple for Jerusalem and di two profet help dem.
For di sekond year wen Darius bi king for Persia; for di first day for di sixt mont, God tell Profet Haggai make e give dis message to Zerubabel, Shealtiel pikin, wey bi govnor for Judah and to Joshua, Jehozadak pikin, wey bi di High Priest.
For di eight mont for di sekond year wey Darius dey rule for Persia, God give dis message to Profet Zekaraya, Berekaya pikin wey Iddo bi en grand-papa.