Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Haggai 1:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Naw dis na wetin Oga God wey get pawa dey tok: “Make una tink about wetin dey happen to una!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Haggai 1:5
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make una si as di town walls strong rish and as e dey save, den una go fit tell una shidren-shidren about am.


So Fero go inside en house back. E nor even allow wetin happen worry en mind.


But di rest ones wey nor bilive Oga God word kon leave dia savant and kattles for outside.


Instead, make wi shek and test di tins wey wi dey do kon turn from sin kom meet God.


bikos e si sey wetin e dey do nor good, so e kon stop to dey sin. E nor go die at-all, but e go live.


E kon tell mi, “Man pikin! Listin well-well and look evritin wey I dey show yu, bikos dis na di rizin why dem bring yu kom der, so dat yu go tell Israel pipol evritin wey yu si.”


Di angel tell mi, “Daniel, make yu nor fear. Since di first day wen yu honbol yorsef kon dey pray for undastandin, naim God don ansa yor prayers. So I kom as ansa to all yor prayer.


Wen di king hear wetin dem tok, e nor happy and e kon try to save Daniel komot from dia hand. Until aftanoon dat day, e still dey find how e go take save Daniel.


“My pipol, e good as una dey stay for fine-fine house and my temple skata?”


Una plant many korn, but wetin una harvest, small. Una get food to chop, but e nor dey beleful una. Una get wine to drink, but e nor dey rish una! Even wen una wear many klot, e nor dey make una warm and pipol wey dey work, dia salari nor dey rish dem spend.


“God wey get pawa sey, ‘Make una tink about wetin dey happen to una naw.’


“But wen en eye klear, e kon sey, ‘All my papa workers get food wey dem nor fit chop finish, but hongry don nearly kill mi for here!


Make una test unasef to know weda una still dey inside di faith; e good make una shek unasef well-well! Una nor know sey Christ dey inside una? May bi una don fail di test!


Instead of una to dey kompare unasef with anoda pesin, make una shek unasef, den una go fit tok about unasef.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ