Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Haggai 1:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Oga God wey dey lead Heaven Sojas tell Haggai sey, “Dis pipol dey sey dis nor bi di rite time to build di temple again.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Haggai 1:2
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So King Jehoash koll Jehoiada with oda priests kon sey, “Wetin make una neva ripair where spoil for di Temple? Naw, make una nor take any money again escept una won use am ripair di Temple.”


As soon as dem just read di leta wey King Atazazes send go give Rehum, Shimshai and di pipol, dem kon rush go Jerusalem go force and stop Jew pipol to ribuild di town.


Judah pipol get one song wey dem dey sing: “Doz wey dey work, dia pawa don fail! Di trobol too mush and bikos of dat, wi nor fit ribuild di wall.”


Lazy pipol dey always sey, “Lion dey outside and e go kill us”, so dem nor go gri go out.


E dey bad to borda yorsef about wetin pipol dey tink about yu, but if yu trust God, yu go dey save.


Any farmer wey dey wait for betta weda, nor go ever plant seed and if e dey look di kloud to know weda rain go fall, e nor go ever harvest wetin e plant.


Time dey to kill and time dey to heal pesin; time dey to skata and time dey to build.


So, anytin wey yu dey do, make yu do am well, bikos wons yu die, yor wisdom, knowledge, work and plans, nor go mean anytin again.


For di sekond year wen Darius bi king for Persia; for di first day for di sixt mont, God tell Profet Haggai make e give dis message to Zerubabel, Shealtiel pikin, wey bi govnor for Judah and to Joshua, Jehozadak pikin, wey bi di High Priest.


So God sey make Profet Haggai go give di pipol dis message:


But di men wey go with Kaleb kon sey, “No, wi nor strong rish to fight dem; di pipol wey dey der get pawa pass us.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ