Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Haggai 1:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 So Oga God kon help Zerubabel wey bi govnor for Judah; Joshua wey bi di High Priest and all di pipol wey kom back from Babilon, so dat dem go fit do di work. All of dem kon start to build Oga God temple. Dem start di work

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Haggai 1:14
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So God make King Pul for Assyria (wey dem still dey koll Tilgat-Pilneser) attack dia kountry. E karry Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe go stay for Halah, Habor, Hara and Gozan River and na der dem dey till today.


To take fulfil wetin God promise Israel pipol thru Profet Jeremaya, God kon make King Cyrus for Persia rite law give all of dem for en kingdom for di first year wen e start to rule.


For di first year wey King Cyrus for Persia dey rule, God make wetin E tok thru Profet Jeremaya happen. E make King Cyrus rite, send and read dis kommand for evriwhere for en kingdom, so dat evribody go hear:


Di head for each family for Judah and Benjamin tribe, di priests, Levi pipol and evribody wey God tosh dia heart kon go back to Jerusalem go build God Temple.


Wen Zerubabel, Shealtiel pikin and Jeshua wey Jozadak born hear dia message, dem kon start to ribuild di temple for Jerusalem and di two profet help dem.


Awa oga, wi wont make yu know sey wi go Judah aria kon si sey dem dey build di great God Temple with big-big block kon use iron wood take do pilas for di wall. Dem dey do di work with kare and e dey go well.


So, wi kon kontinue to dey build di wall and bikos di pipol dey ready to work, wi kon almost build am rish half of how e high rish before.


Wen yu go war, yor pipol go dey happy to follow yu go fight. Na holy garment dem wear for yor body and yor pawa go dey fresh evriday like morning dew.


For di sekond year wen Darius bi king for Persia; for di first day for di sixt mont, God tell Profet Haggai make e give dis message to Zerubabel, Shealtiel pikin, wey bi govnor for Judah and to Joshua, Jehozadak pikin, wey bi di High Priest.


So, Zerubabel wey bi Shealtiel pikin with Joshua, Jehozadak pikin wey bi di High Priest and evribody wey kom back from Babilon kon obey Oga God message wey E tell dem thru Profet Haggai and dem kon dey follow and obey God word, well-well.


for di twenty fourt day for di sixt mont for di sekond year wey Darius bi king for Persia.


E tell am make e go tell Zerubabel wey bi Shealtiel pikin, wey bi govnor for Judah, Joshua wey bi di High Priest and all di pipol sey,


make e go tell Zerubabel wey bi govnor for Judah: “I go soon shake heaven and eart


So my friends, make una dey strong and nor let anytin shake una. Make una always dey do God work, bikos una know sey, evritin wey una do for God, get gain.


Wi tank God wey give Titus di kind mind wey I get to help una.


make E give una evritin wey una nid to do wetin E wont. Anytin wey good for en eye, make E do am inside us thru Jesus Christ. Make all glory bi Jesus Christ own forever and ever. Amen!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ