Haggai 1:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English1 For di sekond year wen Darius bi king for Persia; for di first day for di sixt mont, God tell Profet Haggai make e give dis message to Zerubabel, Shealtiel pikin, wey bi govnor for Judah and to Joshua, Jehozadak pikin, wey bi di High Priest. အခန်းကိုကြည့်ပါ။ |
So dem start work for di sekond mont for di year afta dem kom back to Jerusalem where di temple dey. Zerubabel wey Shealtiel born, Jeshua wey Jozadak born, plus all di pipol, di priests and Levi pipol wey kom back from Babilon kon join do di work. Dem put Levi pipol wey don rish twenty years or wey don old pass dat age small make dem dey supavise di work.
Wen di pipol hear wetin dem read for di law, di word tosh dem sotey dem kon start to kry. So Nehemaya wey bi di govnor, Ezra wey bi priest wey know di law well-well and Levi pipol wey dey esplain di law kon tell all di pipol, “Today dey holy for di Oga wey bi una God, so una nor suppose mourn or kry.